Wia dis foto come from, Getty Images
Di President of South Africa Cyril Ramaphosa don finally announce members of di new National Executive for im second term administration.
President Ramaphosa make di announcement for live broadcast on Sunday, 30 June.
Dis na afta di pipo of South Africa don wait anxiously to know who go dey President Ramaphosa cabinet despite di coalition wey happun bifor im inauguration for 19 June 2024.
South Africa parliament bin re-elect Ramaphosa as di kontri president for Friday 14 June 2024. Dis na afta one landmark coalition deal between di governing African National Congress (ANC) and some opposition parties including di Democratic Alliance (DA).
President Ramaphosa say di men and women wey im appoint as cabinet members come from all corners of South Africa.
End of Recommended articles
“Dem reflect di diversity of our nation. Dem get responsibility to serve di pipo as a whole,” di president tok.
E say none of di members of di National Executive dey appointed to serve di interests of a particular constituency, a particular party or a particular section of society.
“Collectively and individually, dem dey responsible to di pipo of South Africa,” e tok.
Wia dis foto come from, Screengrab/South Africa Presidency
Wia dis foto come from, Getty Images
President Ramaphosa say in di spirit of partnership and collaboration, di incoming goment go work togeda wit oda formations to convene a national dialogue.
E say through di national dialogue, all parties, civil society groups, labour, business and oda stakeholders go dey invited to work togeda to address di critical challenges facing di nation.
“We call on all South Africans to participate for dis national dialogue and to give dia support to dis Goment of National Unity as e start im work.
“As leaders of political parties, as Ministers and Deputy Ministers, as public representatives, we understand and accept di responsibility that we bear.
“We all dey called upon to serve di pipo pipo of dis kontri and we go do so to di utmost of our ability,” di president add.
Wia dis foto come from, x/SABCNews/@lebotshangela
© 2024 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

More Stories
New ITU Report Finds Community Networks Are Key to Reaching the Unconnected
Digital Coercion: How Inaccessible Design Strips Financial Privacy
The Need to Reimagine the WSIS Forum